মঙ্গলবার, ০৪ মার্চ ২০২৫, ০১:৪৮ অপরাহ্ন

Canada announce new express entry draw for workers to reduce labour shortage

  • আপডেট সময় মঙ্গলবার, ৪ মার্চ, ২০২৫

Canada don announce new categories for di express entry draw for workers and also add to di list of occupations wia pipo fit apply to work and permanent residence.

Di immigration, Refugees, and Citizenship Canada (IRCC) bin reveal say di new category for di 2025 Express Entry draws na to address di shortage of labour skills for Canada economy.

IRCC say dis new announcement na to focus on di federal economic class wia dem go invite candidates wey get experience to work for Canada to apply for permanent residence.

Express Entry na Canada flagship application management system for dose wey wan permanently migrate to Canada through di federal skilled worker program, di federal skilled trades program and di Canadian Experience Class.

According to IRCC, immigration dey account for almost 100% of Canada labour force growth and e dey help dem to address labour shortages for important sectors.

For 2023, IRCC bin introduce category-based selection to target specific occupations and skills wey dey for high demand and dis 2025 system na to torchlight on issues of labor shortages, demographic goals, and Canada bilingual identity.

Sectors wey dey involved

Na some key sectors Canada dey target to strengthen dia work system and include some occupations wey dem need for di kontri so pipo wey dey japa come di kontri go fit apply.

Canada wan strengthen dia Francophone immigration target and dem go invite candidates wey get strong French language skills.

Dem go also invite candidates wey get work experience for fields like:

  • Health care,
  • Social services, such as family physicians, nurse practitioners, dentists, pharmacists, psychologists and chiropractors
  • Trades, such as carpenters, plumbers and contractors,
  • Construction, such as Contractors and supervisors, oil and gas drilling and services,
  • Education, such as teachers, child care educators and instructors of persons with disabilities

For June 2022, di govment of Canada bin make changes to di Immigration and Refugee Protection Act to allow for selection of immigrants based on key attributes wey go support dia economy.

Canada say dis priorities go help dem maintain di focus on bringing workers wey get skills to contribute to Canada future and den transition more temporary residents to permanent residence.

Meanwhile, for early 2025, Canada launch four new permanent residency (PR) pathways despite say dem reduce dia kontri annual immigration targets.

Dem design dis new programs to address labour shortages, encourage language diversity, and meet di caregiving and economic needs of Canada communities, Canadian authorities tok.

Bifor now, Canada don introduce different policies for dia immigration system wey go affect pipo wey go japa come di kontri.

Canada Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, Honourable Marc Miller, say Canada dey build a dynamic workforce wit workers and professionals from fields wey dey in high demands for di kontri.

“Our approach dey ensure say immigration remain a key driver of Canada growth, to help businesses grow and support communities across di kontri.”

শেয়ার করুন

এ জাতীয় আরো খবর

ভ্রমন সম্পর্কিত সকল নিউজ এবং সব ধরনের তথ্য সবার আগে পেতে, আমাদের সাথে থাকুন এবং আমাদেরকে ফলো করে রাখুন।

© All rights reserved © 2020 cholojaai.net
Theme Customized By ThemesBazar.Com